
Life I dey tell you be like travel , and Na so to hammer be.
To make am for this life you no need chuwa chuwa , no cornilus .
To bin make am na leg by leg ,if you get long leg sha use am
so na je je you go dey waka, make your way pure

Chuwa chuwa still bin dey, but e no pure . By mistake if kasala burst , the matter go bad, everything don spoil
But inside dis life wey no balance , na corni corni join with chuwa chuwa hammer people dem dey give gbosa, dey carry nash for , we don bin fash our brothers and sister wey them hussle pure
Sha las las we go dey alright .🦋
